The President of Nigeria has announced the death of Chief of Army Staff, Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja.
Chief of Army Staff, Lt General Lagbaja die for Lagos on Tuesday night.
Dis dey come afta president Bola Ahmed Tinubu announce di appointment of a new acting Chief of Army Staff (COAS).
Oga Tinubu appoint Major General Olufemi Olatubosun Oluyede as di acting COAS to takeova from Lt-Gen Taoreed Lagbaja wey neva appear for any public function for sometime now.Late Chief of Army Staff Lagbaja die at di age of 56 afta spending one year and some months for di position.
For di statement released by Bayo Onanuga, di special adviser to di President Information and Strategy, Oga Tinubu praise di late Chief of Army Staff for im professional growth during im service.
“President Bola Ahmed Tinubu, Commander-in-Chief of di Armed Forces, regret to announce di passing of Lt. General Taoreed Abiodun Lagbaja, Chief of di Army Staff, for age 56,” di statement tok.
“E pass away for Tuesday night for Lagos afta a period of illness.”
Lt. General Lagbaja dey survived by im wife, Mariya, and dia two children
